Chapter 5: New Faces, Old Pains
Final year of secondary school, Timi bring him babe come house.
Na that kain time wey family dey prepare jollof rice and Fanta for guest. Me I dey room dey practice essay, I no even know say visitor dey come.
Nobody even tell me.
Na so my name dey always miss for family plan. If to say I be car, dem for forget my key inside house.
That time, I dey live for hostel. Because I sick, I come house early, jam my future sister-in-law, Halima, as she dey visit.
I no even wear correct cloth. Just one big T-shirt. I see Halima, I just manage smile.
I notice Halima shock.
Her face do one kind, but she try hide am. Girls sabi package surprise for face, but e still leak.
She just pinch Timi.
Na small pinch, but na sharp code. I see am, but I no talk.
“You dey always talk about your small sister, but you no mention say you get two!”
That one land like stone for my chest. I no know whether to laugh or disappear.